President Ruto speech today: Full speech of Kenya president on Finance Bill 2024 - BBC News Pidgin (2024)

President Ruto speech today: Full speech of Kenya president on Finance Bill 2024 - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Reuters

Kenya President William Ruto don make u-turn ontop di Finance Bill 2024 wey cause kasala for di kontri.

President Ruto tok for di nationwide address wey im give for Wednesday 26 June, 2024 in Nairobi.

Di president tok afta di youths of Kenya protest against di bill.

One bold and new generation of young Kenyan protesters bin enta streets to force di goment stop some of dia unpopular tax proposals.

Wetin start as anger on TikTok about one controversial finance bill bin rocket into a revolution – and no be political parties organise dem.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

On Tuesday, hundreds of protesters wey wear trainers, wey feel say Kenyans dey already overtaxed wit little to show for am, face police wey fire tear gas to march enta di capital, Nairobi.

On Wednesday, President Ruto say im dey ready to work wit di young pipo afta di protest bin lead to di death of young pipo.

“Having reflected on di continuing conversation around the finance bill 2024 and listening keenly to di pipo of Kenya, wey say dem no go get anytin to do with di finance bill 2024.”

“I concede and diafor I no go sign di 2024 finance bill and e go dey subsequently withdrawn. Di pipo don speak.”

Ruto say im go begin listen to di youths so as to know dia needs and wetin dem want.

“E dey process, sake of say we don comot di finance bill to follow young pipo tok - we go listen to dem, listen to dia needs, dia ideas and wetin dem think."

Di president say im dey sad about di pipo wey die for di protest.

“Young pipo no suppose lose dia life. Na very unfortunate situation. Doz wey die go dey accounted for. I send my condolences to everyone wey lose lives for di protest.

Reduced budgets and oda tins Ruto tok

President Ruto also announce say im goment go reduce travel budgets and di parliament wit judiciary go also cut dia own budgets.

  • "I direct immediate further measures to reduce expenditure, to start wit di Executive Office of di President and extending to di entire executive arm of goment.
  • I direct say operational expenditure for di Presidency be reduced to remove allocations for di confidential vote, reduce travel budget, hospitality and purchase of motor vehicles, renovations and other expenditures.
  • I propose say make di Parliament, di Judiciary and County goment work wit di National Treasury to also undertake budget cuts to ensure say we dey do wetin we dey tok say make we live within our means.
  • I propose an engagement wit young pipo of our nation to listen to dia issues and agree wit dem on dia priority areas of concern.
  • I also propose say within di next 14 days, a multi-sectoral, multistakeholder engagement go hold wit a view to tok di way forward on matter wey relate to di content of di bill as well as strengthening our fight against corruption."

Wetin Ruto tok ontop di finance bill protest

President Ruto bin claim say 'criminals' don hijack di anti-tax protests wey dey happun now for im kontri.

Ruto tok say organised criminals don "enta and hijack," di anti-tax protest as im bin dey address di violent I-no-go-gree wey bin occur on Tuesday.

"E dey very painful for Kenya say dangerous pipo don hijack conversation wey important like dis," im kontinu.

"E no dey in order say criminals wey dey pretend to be peaceful protestors fit raise terror against di pipo - and expect to go scot free."

E say im goment don deploy all available resources to fight di pipo wey dey "undermine di security of di kontri".

Di president describe di protest as threat to national security.

E add say im goment go treat evri threat to national security as "existential threat to our republic", and say all di actors wey get hand for di threats dem go see dem as "treasonous".

  • Kenya president announce indefinite postponement of school resumption inside nationwide broadcast to address flood palava
  • Key points you suppose know about Kenya housing tax law wey President Ruto sign
  • Gas blast for Kenyan capital kill three, wunjure almost 300

Wetin Kenya goment first comot for di Finance Bill

VAT on bread, vehicle and sugar

Kuria Kimani wey be di chairmo of di National Assembly Finance Committee say di taxes and levies wey dey imposed for di finance bill no go dey again.

Kimani tok say di 16% VAT wey dey ontop bread go comot. E say e go lift di burden on di pipo.

Im also announce say di Kenya goment don comot di 2.5% wey dem bin dey propose to impose ontop vehicle.

Kimani also announce di removal of excise duty ontop vegetable oil. For di same statement, di chairmo say VAT ontop transportation of sugar go also dey removed.

Increase in mobile money transfers and VAT on financial services

Di chairmo of di National Assembly Finance Committee say di increase for mobile transfers no go dey again. Im tok am wen im bin dey read di statement on Tuesday.

“Increase for mobile transfer no dey,” Kimani tok.

Di VAT ontop financial services and oda foreign exchange transactions go also comot, according to Kimani.

Levies on Housing fund and locally manufactured products

Kimani say products wey be locally manufactured no go attract Eco Levy. Im add say e go help boost di manufacturing capacity for Kenya.

“Locally manufactured products wey include sanitary towels, diapers, phones, computers, tyres, and motorcycles, no go attract di Eco Levy,” Kimani tok.

Di chairmo add say di levies ontop Housing Fund and Social Health Insurance go become income tax and “e go put more money for di pockets of employees."

President Ruto speech today: Full speech of Kenya president on Finance Bill 2024 - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Delena Feil

Last Updated:

Views: 6298

Rating: 4.4 / 5 (45 voted)

Reviews: 92% of readers found this page helpful

Author information

Name: Delena Feil

Birthday: 1998-08-29

Address: 747 Lubowitz Run, Sidmouth, HI 90646-5543

Phone: +99513241752844

Job: Design Supervisor

Hobby: Digital arts, Lacemaking, Air sports, Running, Scouting, Shooting, Puzzles

Introduction: My name is Delena Feil, I am a clean, splendid, calm, fancy, jolly, bright, faithful person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.